Author Topic: Business Studies  (Read 1897 times)

admin

  • Administrator
  • *****
  • Posts: 89
    • http://www.gsso.net
Business Studies
« on: April 14, 2003, 07:47:18 PM »
Business Studies

YES, NAH ME AGAIN, NA KELECHI NWOKOCHA. I just know if una remember the Business studies teacher wey dey teach for JSS klasses. Una fit remember that word she dey yan, shebi na \"SaaaVE YOoooUR HeeeEADS\" That time,she dey teach us how we surppose use typewriter. No pesin know wetin she the talk. She dey tell us say make we use ribbon, people dey think say she dey talk ribon wey small small girl dey use tie for head. She dey say \"Uze the margin. Make sure dat dey ribon iz in dey right place\" \" Today you are going to learn how to uze dey typewriter as well as Learning shorthand.\" (Make you com cut my hand now, if you dey say you dey do shorthand) Na waoooh dat woman giv me joke. Dey only place wey she dey flog na mostly for head and back of dey hand. Dey woman sef dey walk like Pigeon or shebi na vulture. How i wish i go remember her name. Ibi like say she dey drive sky blue 504 Pegeot wey don mud. Abeg, make pesin tell am say computer na the typewriter wey we dey use today ooooh!! Make pesin go drag am into this Year 2000 oooh!!!.........YOU HEAR?

DON SEGA

admin

  • Administrator
  • *****
  • Posts: 89
    • http://www.gsso.net
Business Studies
« Reply #1 on: April 14, 2003, 07:47:56 PM »
Nna I remember de woman!!! Dat woman show me pepper for Jss2 and 3. Single english dis woman no fit to spoke! She de always carry wooden ruler de knock pesin for hand. De woman bin de teach us one day and she come say we go learn about something wey dem de call \"Frankin mwanshin\" na so she take pronounce de thing!! Me just dey de jones I ne learn de thing na for SS2 na im I com realize sey de thing wey she bin de talk na \" Franking Machine\" Olololoooo.....!!!! Dat woman worry. Abeg if any man remember im name make dem talk.

Peter Opara....(Peroo) Class of 97